Open Letter To The First Lady
Auntie Patience, Good mornin’, ma. I know say you no sabi me. My name na Osemhen, and I get one business wey I wan make we discuss. D tin consan the campaign wey you dey helep our Presido, Uncle Jo and all im ‘umblerra’ friends do. Auntie, you try. Even though you no too sabi English, you dey make effort. You dey try relate wit your pipul, try console dem. But dem be ingrate! You know say for dis we kontri, pipul plenty wey get bad mouth. Na so dem go sidon, dey laff wetin you talk wen you give speech. Instead make dem understand the message wey you get for mind, dem go dey find mistake for the English. Dem laff wen you talk say Uncle Jo and Bros. Namadi “is good people.” Even say the English no beta, shey dem no sabi say you been wan say Uncle Jo and Bros. Namadi na beta person? Which one come hard for dere? Abi, na the one wen you talk say “the people sitting before …